
“Dis na di day we don dey wait for!,” Di Nigeria minister of aviation bin declare as im announce guidelines for di kontri to resume international flights, afta more than 4 more months of shutdown.
First, oga Hadi Sirika confam say 5 September resumption date dey comfamed as im ministry dey satisfied say all preparations to ensure safe international travel dey okay.
Like di goment announce before, Nnamdi Azikiwe International Airport Abuja – from wia today 3 September press briefing take happun – and Murtala Muhammed International Airport Lagos, na di only two airports wey don get clearance to re-open.
Approved rules for travellers
Incoming travellers must test negative to Covid-19 wit proof PCR test result for proof
Di traveller suppose don do di test within 4 days of departure (but preferably 72 hours)
For certain countries, Covid-19 PCR test results must come from specified laboratories
All travellers wey dey come Nigeria must register for https://nitp.ncdc.gov.ng/
Travellers must upload dia negative Covid-19 PCR test results for di website
Travellers go do anoda test on 7th day afta arrival. Dem fit chose location and date for result collection
Di same website na wia travellers fit do self-reporting
Thermal screening go happun for di airports
Sanctions
Any traveller wey no carry negative PCR Covid-19 test come, or di result old pass 4 days before departure, go face sanction, plus di airline wey carry dem come.
If di passenger no be Nigerian, di goment fit block dem to enta di kontri, and return dem back to wia dem dey come from
Di airline wey carry dem come, go bear di cost of di passenger return
Di airline go pay fine of $3500 for every passenger wey no meet di requirement
If di passenger na Nigerian, di goment go allow dem enta di kontri, but dem must do 7 to 14 days quarantine
Di Nigerian passenger go pay for di cost of di quarantine and PCR test
Pesin wey don test Negative for Covid-19 afta 7 days of self-isolation/quarantine go dia way on day 8
Approved list of Airlines for Abuja
Di minister also release informate on di 14 airlines wey get approval to begin operate (Abuja and Lagos) and di conditions dem get.
Some of di airlines include British Airways, Delta Airlines, Qatar Airways, Ethiopians Airlines and Egypt Air. Oda popular airlines like Etihad Airways and Air France no get approval.
See full list below:
Be the first to comment